On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth for de late gospel singer, Osinachi Nwachukwu mata ontop abuse for marriage. Dis woman wey God bless with beta voice just die like dat bcos of bit bit from her husband. Some pipo talk say wetin make Osinachi stay for de marriage till she die na bcos say she be gospel singer and bcos pipo know her well well for her church. Dis na bcos churches nor dey care about wetin women dey suffer for marriage, wetin dem know be say bible nor support divorce. For our tori today, una go tell us wetin una tink about dis mata. Say e beta make woman die for marriage bcos she dey go church or bcos of family and society? When be di right to quit? Relationship Corner: “my baby resemble my neighbour, my husband say na DNA test go settle de mata” Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na for our relationship corner. Today, one woman send us massage say she just born new pikin but de wahala be say di pikin resemble her neighbour. She say her husband don dey suspect say she do kuruke wit dier neighbour, say dem must do DNA test. She talk say she nor know wetin to do, say make we advise her. Abeg, make una help us chuck mouth for dis tori. Our Everyday Tori crew go sit down Kanganda today to chuck mouth for de 30min tori. Make una join us chuck mouth. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter