On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth for the sacrifice wey people dey make for love.
Some people dey do de “unthinkable” for love. No wonder dem talk say love dey blind.
For our Tori today, una go tell us wetin una tink about dis love mata. Say love fit make man wey dey HIV negative go marry HIV positive woman?
Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na de tori wey one of our person wey dey chuck ear for our tori send to us say make we help am chuck mouth put.
The woman talk say dem don marry for 10 years but dem nor get pikin. She come say make dem go adopt pikin but de man say no.
Now, she say make we tell her wetin she go do.
Abeg make una help us chuck mouth for dis tori….make de woman continue wit de marriage or make she comot?
Our Everyday Tori crew go sit down Kanganda today to chuck mouth for de 30min tori. Make want make una join us chuck mouth.
Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter