On Everyday Tori today, we de ask say, ” Una think say our society de fair to women at all? This question de come as one Nigerian singer, Oxlade, come out , come announce say him don secure new contract with Columbia records, despite say, him sex tape bin leak one month ago , like Tiwa Savage own.
The koko be say, the singer announce for him Twitter page say, “New beginnings. New Blessings. Let the year begin.” de thing come vex some people as dem come de shout say Nigerians dey ‘hypocritical and biased to the women folk.
Their argument be say, immediately Tiwa sex tape leak, she lose plenty endorsement deal and plenty backlash.
How una see this matter? Abi na true? How we fit break this bias?
Another tori wey we bring come now say,
Nice (Andrew) Omininikoron, the driver of the Bus Rapid Transit vehicle wey dem arrested in connection with the brutal murder of him passenger, Oluwabamise Ayankole, don enter another egbese as one lady passenger don accused am engaging in illicit acts and raping her.
E bi like sey we never hear the last for dis Miss Kirikiri Cell, Chidinma mata, as Reno Omokri, and Dr Sam Amadi don dey argue on top.
Relationship Corner
For our relationship Corner, one young girl write us , dey beg for our advise as she say her senior cousin, de always attempt to sexually molest her when she de sleep. According to her , her papa get stroke and her siblings dem still dey small even as this her wicked cousin no dey respect her mother.
Her question be say if she report am, him no go kill her? She need our advise.
Make una follow us chuk mouth for all this mata for all our social media handles; Facebook, YouTube, and Twitter