On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth again for dis fuel scarcity mata wey don tie serious wrapper for Naija. Fuel don turn gold now so tei pipo dey sleep for fuel station just to buy fuel. And unto say Naija nor dey carry last, pipo wey dey sell black market don open shop for road. On top say no fuel to buy, light nor kukuma dey. One psychiatrist don come out come talk say fuel scarcity dey predispose Nigerias to mental illness. Dis na even as dem don already talk am say about 60% of Nigerians get mental illness ontop depression.
We’ve got the edge. Get real-time reports, breaking scoops, and exclusive angles delivered straight to your phone. Don’t settle for stale news. Join LEADERSHIP NEWS on WhatsApp for 24/7 updates →
Join Our WhatsApp Channel