Una sabi say people know Nigeria for her unique cultural heritage, and one aspect of that cultural heritage na the use of aso-ebi during special ceremonies (like marriages, birthdays , burials etc) to celebrate with family members and friends.
We all sabi say, for the high class Nigerian woman , asoebi no be only fashion statement o, as e don become status symbol for some. For the super-rich wey want show class distinction, their aso-ebi dey cost like between N100,000 to 250,000
Everyday Tori notice say, Aso-ebi don join other household items wey de suffer low patronage from women as the economy d bite harder. Out aunties and sisi dem no de even look that direction again, not to talk of to remember the tailors wey d make dem clothes.
Wetin una think? Una believe say the devastating state of the economy wey don affect the prices of goods and services nai dey tell on women abi, our women just repent come dey prioritise their needs?