On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth today for dis mass exodus of Nigerians to obodo oyinbo wey we wan call obodo Oyinbo tourism. Our youths nor wan send at all at all. Dem still believe sey their destiny abi luck dey obodo Oyinbo as nothing dey here to beta their future. The ones wey dey do Yahoo Yahoo, abi 419, e nor dey easy for dem too as EFCC and even Police dey dabaru their plans.