On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth for de mata wey concern small pikin dem on top kidnapping, trafficking for Naija. For Tori nowadays, na so so mata wey concern small pikin dem you go hear. If you nor hear say neighbour don kidnap neighbour pikin, you go hear say relative don kidnap aunty or uncle pikin. Still on top de pikin dem, you go hear say papa rape e own pikin or person don carry small pikin go do money ritual. For our Tori today, una go tell us wetin una tink about dis small pikin dem wey don become victims for bad pipo dem. Say na small pikin dem fault say Naija get as e be, una sure say all dese crime ontop small pikin dem go fit stop for Naija? Relationship Corner Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na for our relationship corner. Person send send text message give us say e wan marry girl wey don born pikin before but e family nor agree. De guy say make we advise am – say make e fashi e family marry de lady or make e forget about de lady? Abeg, make una help us chuck mouth for dis tori. Our Everyday Tori crew go sit down Kanganda today to chuck mouth for de 30min tori. Make una join us chuck mouth. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter