On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth for de tori wey concern women and their carrier ontop pikin.
Many women don leave their work because dem still dey born pikin and dem dey wait till after dem don born all their pikin finish, dem go look for work again.
some, na their husbands tell dem to leave their work so dat dem look after de small small pikin wey dem born.
Some women even try to look for pipo to look after their small pikin so dat dem go face their career, but when dem check the cost, their salaries no fit cover am.
Some work, dem no dey employ women wey still dey born, some dey give de women how many years dem go work before den fit born.
For our Tori today, una go tell us wetin una tink about dis mata, say women suppose de put their career on hold as dem still dey born? Pikin suppose be barrier to woman carrier? Husbands dem wey dey tell their wives to leave work for pikin, na bcos dem dey selfish or na bcos dem get money to provide everything for their family?
Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na one 28-year-old woman wey dem de call Justina Yakubu for Mararaba-Mubi for Adamawa State, wey dem carry go court ontop her pikin wey she sell for N120,000.
Abeg, una go tell how una see dis mata, say pikin don become market wey dem dey sell? Na bcos of poverty or wetin una feel say de make papa and mama dem de sell their pikin now?
Our Everyday Tori crew go sit down Kanganda today to chuck mouth for de 30min tori. Make want make una join us chuck mouth.
Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter