On Top Wetin Dey Happen today, we dey ask why BiG man wey dem arrest after they commit offence dey always fall sick.
Plenty example dey of BIG men wey commit offence and after dem arrest dem, dem go court tell court say dem sick make court free dem to go hospital.
The one wey dey fresh among the BIG men na Abba Kyari, wey be policeman wey suppose to dey catch people wey put their hands for bad bad things wey dem accused say him self do bad thing. He don come out tell court say hin dey sick make dem release am after dem arrest am keep am for detention.
My people, how una see this matter?
Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na on top one house wife wey dey jealous so tey, she kill her rival on top kerewa matter with the husband ooo. The two women dey live inside one room and parlour with their husbands for Ondo State.
Our Everyday Tori crew go sit down
Gidigba today to chuck mouth for de 30min tori.
Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter.