On top Wetin Dey Happen, we dey chuck mouth for de Kasala wey burst out for Soludo swearing in ceremony for Anambra State. The fight wey happen between Bianca and Obiano wife for Soludo swearing in ceremony today for Anambra State don catch fire for social media. We hear say Obiano wife be come late for the occasion and she be dey go round dey salute everybody, but when she waka meet Bianca, she come say “Bianca so you are here, I thought you said you will never attend any APGA event again.” Na de question wey scatter Bianca head wey she stand up give Obiano wife dirty slap before she come drag her wig comot for her head. We hear say de fight cause wetin oyinbo de call “disruption for the oath of office wey Soludo be dey take. For our Tori today, una go tell us wetin una tink about dis slap mata. Say Bianca do well wey slap Obiano wife? Obiano wife do wrong wey she ask Bianca question? Relationship Corner Another tori wey we get for ground dis hot afternoon na for our relationship corner. Person send mail give us say her moda inlaw come visit dem for Abuja but serious wahala come happen. De wahala be say her moda in-law say she nor go eat food wey chef cook, say na de woman suppose use her hand dey cook food for the house. The woman say since wey she marry, na chef dey cook and her husband never complain but her moda in-law nor wan understand, she don talk say she wan go bcos she nor wan eat food wey chef cook. She say make we advise her – make she allow de woman go or make she allow her bring gbege for her marriage? Abeg, make una help us chuck mouth for dis tori. Our Everyday Tori crew go sit down Kanganda today to chuck mouth for de 30min tori. Make una join us chuck mouth. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter