On Top Wetin Dey Happen today, we dey ask na wetin be the difference between the children wey we dey born today and the one before them? Many pipu believe say our value system don drop well well. Dem say parents of nowadays no bring up their children the way their own parent train them. Dem say in the area of greeting, labour, schooling, etc., many thing don change from wetin we meet wen we dey grow up. The belief be say children of olden days dey more rugged, dem say dem fit trekked even for long distance to schools but wetin we get today na school bus. That time, television no dey but now dem dey watch Netflix, YouTube etc. Olden days children get reading culture but nowadays children get internet culture. Wetin be una thought on top this matter?! Relationship Corner: For our Relationship corner today, one man say she need our help ooo, say he don taya for her wife on top say she no dey take care of the home and the children. He say he wan drive the woman comot marry another wife My people, how una see this matter? Our Everyday Tori crew go sit down Gidigba today to chuck mouth for de 30min tori. Make una follow us for our social media handles: Search @LeadershipNGA for YouTube, Facebook and Twitter.